The Lord na my shepherd, I dey kampe.
2. E make me sidon for where better dey flow yanfu yanfu. And come put me next to stream make my body thermocool.
3. see as Baba God reposition my soul for Restoration come dey lead me
dey go through express road of righteousness because of Hin name.
4. You check am Na, If only me Waka come, even come where arm robbers, 419 and juju people boku, come even join boko haram reach valley of the shadow of death sef, liver no go fail me. Your rod and staff nko? Na so dem dey like backbone dey comfort me.
5. You don arrange good fufu and Amala on top table make I chop. See bad belle people dey look waa waa waa. You rub me for head with vaseline intensive lotion. My cup come be like River Niger dey troway dey go.
6. True true, better life and mercy go dey follow me. And I go tanda for God house Gidigba... I no go
comot for wia better dey. God Almighty, Na you biko! AMEN.

No comments:
Post a Comment